Obadaya 
Introdushon 
Wen Babilon sojas enter Jerusalem for 540 BC, dia neighbours for Edom join Babilon sojas pak evritin wey dey di town go. Aldo Esau na Edom pipol grand-grand papa and Jakob wey bi Israel pipol grand-grand papa, na Esau broad, Edom pipol go help Babilon sojas kapture, kill and karry many Judah pipol go Babilon as slaves. Edom pipol nor sorry for Jerusalem pipol, as dem join di enemy sojas to skata Jerusalem. Profet Obadaya dey among di pipol wey Babilon sojas leave for Jerusalem wen dem skata and karry pipol go Babilon. E kon profesai against Edom pipol, bikos of di way dem trit Israel pipol wey bi dia relashon and neighbour and help dia enemies distroy dia town. E also tell en pipol sey God go kom save and make dem prosper again. For di end, e kon tell Judah pipol sey, Judah kingdom go kon bi God own again. 
 
 1
God Go Judge Edom 
 1 Dis na di vishon wey God give Obadaya about Edom pipol. God send en savant kom di nashons and dem hear di message wey God give dem sey: 
“Make una ready! 
Make una gada una sojas go fight Edom pipol!” 
 2 God tell Edom pipol, 
“Make una si! 
I go make una pipol weak and small well-well 
among all di nashons and pipol go hate una! 
 3 Una pride don deceive una, 
bikos una dey stay under rock where una dey save 
kon build big house on-top mountin. 
So una dey boast sey, ‘Na who go fit kon meet 
and attack us for der?’ 
 4 But even if una fly like eagle or build una house among di stars, 
I go bring una kom down!” 
Na so mi, God, tok. 
 5 “Wen tif kom rob yu for yor house for nite, 
dem go only tif wetin dem wont! 
Wen pipol go plok grape for dia vineyard, 
dem dey leave some for poor pipol! 
But una enemies go distroy una finish! 
 6 Dem go tif evritin wey dey for Edom land! 
Even di ones wey dem hide, 
dem go look for dem kon karry dem go! 
 7 Doz wey dey help una go turn against una. 
Dem go help una enemies porshu una 
komot from una land. 
Even doh dem dey plan to deceive and distroy una, 
dem go promise una peace. 
Una friends wey una trust pass, 
go set trap for una and una nor go even know. 
 8 For dat time, one singol wise pesin 
nor go dey for Edom land again. 
Bikos on-top Edom mountin, 
na der I go for distroy all doz wey get sense.” 
Na so mi, God, tok. 
 9 “Doz strong sojas from Teman go fear 
and dem go kill evribody wey dey Edom mountin.” 
Why God One Ponish Edom 
 10 “Bikos una use wikedness take kill una brodas for Israel, 
na shame and distroshon go follow una forever. 
 11 Wen dia enemies dey attack dem, 
una stand dey look and nor gri help dem. 
Strenjas attack and karry all dia propaty 
kon trow dice take divide Jerusalem, 
but una bihave like sey Israel na una enemy. 
 12 Una nor for dey happy wen dem karry una brodas 
as slaves go anoda land. 
Una nor for happy at-all 
wen Judah pipol dey sofa all dis tins. 
Una nor for tok anyhow 
for dat time wey Israel dey sofa. 
 13 Una nor for enter my pipol town 
wen dem dey face wahala kon tif dia propaty. 
Una nor for join dey tok anyhow 
wen my pipol dey sofa. 
Una nor for go tif my pipol propaty 
wen una si sey dem dey weak. 
 14 Una nor for stand for road 
dey kill doz una brodas wey dey try to eskape 
and una nor for katch dia pipol 
wey run as dem dey sofa. 
God Go Judge Di Pipol 
 15 “God Judgement dey kom for all di nashons! 
Just as una do to Israel, na so too dem go do una. 
All una evil works go fall for una own head. 
 16 Just as una swallow my pipol for my holy mountin, 
na so too una and di oda nashons 
go swallow di ponishment wey I go give una. 
Una go drink kon stagga 
until una disappear komot from dis eart. 
Israel Go Win 
 17 “But doz wey eskape, 
go dey Mount Zion and e go dey holy again. 
Israel pipol go kom back kon take all dia propaty. 
 18 Jakob shidren-shidren go bi fire; 
Josef shidren-shidren go bi big smoke 
and Esau pipol go bi like leaf wey fall for groun, 
dem go burn dem rish groun, 
bikos God don tok! 
 19 Den my pipol wey dey Negev 
go kollect Esau mountin. 
Doz wey dey stay near di hill for Judah 
go take di betta land 
wey dey Filistia, Efraim and Samaria. 
Den Benjamin pipol go take Gilead land. 
 20 Doz wey dem katch for Israel before, 
go kom back 
kon stay for Foenicia wotaside 
wey dey nort for Zarefat. 
Jerusalem pipol wey dem katch and karry go nort 
go kom back to dia house for Negev. 
 21 Doz wey dem save, go-go Mount Zion for Jerusalem 
kon rule all di mountins for Edom 
and Oga God go bi dia king!”