13
God Go Klean Judah 
 1 God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.  2 For dat day, I go remove all di juju name from di land and nobody go remember dem again. I go kill anybody wey klaim sey en na profet, den pipol mind nor go dey to go woship or serve juju again.  3 But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod. 
 4 “For dat day, no profet go fit karry body up, bikos of en vishon. Nobody go sey en na profet or wear profet garment kon dey deceive pipol.  5 Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’  6 Den if pesin ask am, ‘So na who wound yu for yor chest?’ E go ansa, ‘Na my friend house I for wound.’ ” 
Di Sheep Dem Skata 
 7 God wey dey mighty sey, 
“Swod! Make yu go attack and kill 
di shepad wey dey work for mi, 
den all di sheep go skata. 
I go attack my pipol 
 8 and if dem divide all di pipol 
wey dey di land into three, 
two part go die finish. 
 9 I go test di third part wey survive kon klean dem, 
just as dem dey klean silva for fire. 
I go test dem, just as dem dey test gold. 
Den dem go pray give mi and I go ansa dem. 
I go tell dem sey dem bi my pipol 
and dem go sey, 
‘Na di Oga bi awa God.’ ”