2
Jonah Pray 
 1 As Jonah dey inside di fish belle, e kon pray to God.  2 E sey, 
“I kry give Yu wen I dey wahala and Yu ansa mi. 
Naw, I dey kry to Yu from where dead body dey, 
so make Yu go kom help mi and hear my prayers. 
 3 Na Yu God trow mi inside dis deep sea. 
Yu trow mi inside di river 
and di wota and waves kon kover mi. 
 4 Den I sey, ‘Oga God, 
Yu don drive mi 
komot from yor present kpata-kpata 
and I nor go ever si yor holy temple again!’ 
 5 Di wota kover and almost kill mi. 
Naw, I don sink enter di sea. 
Even di leaf dem wey dey di sea, 
don tie my head. 
 6 I sink go under di mountins 
kon enter inside one place 
where I go bi prisona forever. 
But Yu, my God don take mi 
komot from di pit. 
 7 Wen I tink sey my life don dey finish, 
I kon pray give Yu and Yu hear mi 
from yor holy temple. 
 8 Doz wey dey woship juju, 
don abandon di good tins wey God suppose do for dem. 
 9 But as for mi, I go sing praiz Yu; 
I go offa sakrifice give Yu 
kon do wetin I promise, 
bikos na only Yu fit save mi!” 
 10 Den God kon kommand di fish make e go vomit Jonah put for dry land.