47
Message About Filistia 
 1 Before Egypt king attack Gaza, God tok to mi about Filistia sey, 
 2 “Look! Wota dey boil for nort 
and e go rush kom like river wey dey flow. 
Dem go kover di land plus evribody 
and evritin wey dey der. 
Pipol go dey shaut for help 
and evribody for di eart go kry well-well. 
 3 Wen dem hear dia enemies shariot sound, 
dia pawa go fail dem 
and papa and mama go run leave dia shidren. 
 4 Di time don rish wen dem go distroy Filistia pipol 
kon stop doz wey dey help Tyre and Sidon. 
Mi wey bi God go distroy Filistia pipol 
and all di pipol wey kom from Krete wotaside. 
 5 Bitter wahala don kom meet Gaza pipol 
and Ashkelon pipol 
na wen una go stop to kry and pity for unasef? 
 6 Na wen una go kry rish kon sey, 
‘Oga God, na wen Yu go stop 
to kill us with yor swod? 
Wi beg, make Yu put yor swod down 
kon rest small!’ 
 7 But how di swod won take rest 
wen I don gi-am work to do? 
I don kommand am make e attack Ashkelon pipol 
and doz wey dey di wotaside.”