17
Judah Sin And Ponishment 
 1 God sey, 
“Judah pipol, na iron biro 
dem take rite una sin; 
na diamond pin dem take 
karve am for una heart and di altar korna. 
 2 Una shidren nor dey ever forget di altar 
and di Asherah juju wey una put near evry green tree; 
on-top di hill 
 3 and for di mountin wey dey di open kountry. 
Bikos of di sins wey una don kommit for di land, 
I go make una enemies karry una propaty 
and di tins wey una like well-well. 
 4 Una go komot for di land wey I give una 
and I go make una serve una enemies 
for di land wey una nor know, 
bikos my vexnashon bi like fire 
and e go burn forever.” 
 5 God sey, 
“I go curse di pipol wey leave mi 
kon go trust human being. 
Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa. 
 6 Dem go bi like bush for desert or for groun 
where nor-tin go for fit grow. 
Betta tin nor go ever happen to dem. 
 7 But I go bless doz wey trust mi. 
Pipol wey bilive sey I go save dem. 
 8 Dem go bi like tree wey dem plant for near river 
wey en rut spread enter di wota. 
Dem nor dey fear wen hot weda kom 
and dia leaf dey always green; 
dem nor dey borda if rain nor fall 
and dem dey always bring fruit. 
 9 Na wikedness full human being mind and e bad well-well. 
Na who go fit undastand am? 
 10 Na mi wey bi God dey si 
and test human being heart. 
I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life 
and wetin e dey do. 
 11 Pesin wey dey make money with wayo, 
bi like bird wey dey hash egg wey e nor lay. 
Wen e don dey old, 
e go luz all di money wey e get, 
den e go know sey e bi fool.” 
 12 So I sey, 
“My God, na from di biginnin 
Yu sidan for yor throne wey get glory. 
Na only Yu bi di Pesin 
wey go fit save us. 
 13 Na Yu bi di hope wey Israel get; 
so make Yu disgrace doz wey leave Yu. 
Make dem disappear like name wey dem rite for san, 
bikos dem forget Yu 
wey bi di spring wey dey bring fresh wota.” 
Jeremaya Ask God For Help 
 14 My God, make Yu heal mi and I go strong again; 
save mi and I go dey save, 
bikos na Yu I dey praiz. 
 15 Di pipol dey ask, 
“Where di tin wey God sey E won do us? 
Make E kom do dem naw make wi si!” 
 16 But my Oga, 
na Yu choose mi to serve yor pipol 
and dat na wetin I dey do. 
Yu know evritin wey I tok 
and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem. 
 17 Nor make mi fear Yu, 
bikos na Yu dey save mi wen I dey trobol. 
 18 Pipol wey dey tok bad against mi, 
make Yu disgrace dem kon save mi. 
Make fear katch dem, 
but nor make mi dey fear. 
Distroy and break dem into pieces. 
Sabat 
 19 God tell mi, “Make yu go stand for di gate wey Judah king dey pass komot from di town and enter back and yu go still go stand for all di oda gates wey dey for Jerusalem too.  20 Den tell di king; Judah pipol, doz wey dey stay for Jerusalem and evribody wey dey pass di gates sey, ‘Make una listin to wetin God tok.  21 God sey, “If una value una life well-well, for Sabat Day, make una nor karry any load pass di gates for Jerusalem  22 or bring anytin kom out from una house or do any work. But make una si am as holy day for God, just as I kommand and tell una grand-grand papa dem.  23 But una grand-grand papa nor listin to mi, bikos dem sturbon and nor gri obey or learn from mi.” ’ 
 24 “God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.  25 If una do am, den di kings and di prince go enter Jerusalem gates kon get di same royal pawa wey David get. Dem with Judah and Jerusalem pipol go ride dia horse and Jerusalem town go always dey full with pipol.  26 Den pipol go kom from Judah town and from all di village wey dey round Jerusalem; from Benjamin town go rish di hill, mountins and from sout for Judah. Dem go bring burnt ofrin, sakrifice, korn ofrin, incense and tanksgivin ofrin kom my temple.  27 But una must obey mi kon make di Sabat, holy. For dat day, una must nor karry any load pass Jerusalem gate, if una do am, I go burn di gate rish round. Fire go burn di palis rish groun too and nobody go fit kwensh am.’ ”