10
Di True Woship 
 1 Israel pipol, make una listin to wetin God dey tell una.  2 Di Oga una God sey, 
“Make una nor do wetin oda nashons dey do; 
make una nor let doz signs for sky disturb una mind, 
even if oda nashons dey fear am, 
 3 bikos dia relijon dey yuzles. 
Dem dey kut wood from forest 
kon gi-am to pesin wey dey karve 
and e go karve image with di wood; 
 4 use silva and gold take dekorate am 
kon nail am make e for nor fall. 
 5 Dat kind juju bi like image for farm 
where dem plant melon put. 
Di juju nor dey tok; 
dem must karry am waka, 
bikos e nor get leg. 
But make una nor fear dem, 
bikos dem nor go fit wound or help una.” 
 6 I sey, 
“My God! Nobody bi like Yu. 
Yu dey mighty and yor name dey great with pawa. 
 7 E nor get who nor dey fear Yu, 
bikos na Yu kreate evritin. 
Nobody bi like Yu for di whole world. 
Even kings and wise men nor rish Yu. 
 8 Evribody for dis world na fool 
and dem nor get sense. 
Wetin dem fit learn from juju 
wey dem make from wood? 
 9 Na silva and gold from Spain and Ufaz 
dem take kover di juju. 
Na doz wey sabi karve make am with dia hand 
kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave. 
 10 But na only Yu Oga, 
bi di true God. 
Di God wey dey alive 
and Yu go rule forever. 
Anytime Yu dey vex, 
di world dey shake 
and nobody fit stand wen Yu dey vex. 
 11 So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: 
‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. 
So dem go disappear komot from di eart and heavens.’ 
 12 Na God make di eart with en pawa; 
na-im wisdom and undastandin 
E take kreate di heavens and eart. 
 13 Wen E kommand, 
en vois dey sound like tonda and di wota for heaven 
go make nois like lion vois. 
E dey make kloud kom out from where di eart for end. 
E dey bring tonda lite wen rain dey fall 
and E dey make breeze blow 
kom from where E keep dem put. 
 14 All dis bad tins kon turn di pipol to fool 
and dem nor get sense again. 
So, disgrace go follow doz wey dey make juju, 
bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all. 
 15 Di juju dey yuzles, 
so make dem distroy dem trowey 
and time dey kom 
wen God go ponish and distroy all of dem. 
 16 Jakob God nor bi like dem; 
na-im kreate evritin 
and E don choose Israel as en own pipol. 
En name na God wey dey mighty.” 
Distroshon Wey Dey Kom 
 17 Jerusalem pipol! 
Make una pak una tins! 
Make una run komot di land, 
bikos una enemies don surround una. 
 18 God sey, 
“I go trow una komot for dis land. 
Yes! I go kill all of una finish.” 
 19 So I kry, 
“Wi don die finish! 
Awa own worse well-well o-o! 
Wi tink sey wi go fit bear dis one. 
 20 Dem don distroy awa house 
and di rope wey bin whole di house togeda, 
don kut. 
Dem don karry awa shidren go as slave 
and dem nor go kom back again, 
bikos of dat, 
nobody dey to help us build awa house 
or hang di curtains again.” 
 21 But I still sey, 
“Dat na bikos awa leaders nor get sense. 
Dem nor gri go meet God make E tell dem 
wetin dem go do. 
So dem kon do tins like fools 
and all di pipol wey dem dey lead, 
don skata finish. 
 22 So make una listin! 
One news dey kom naw! 
Wahala dey kom from di nashons for nort! 
Dia sojas don skata and turn Judah town 
to desert where animals dey stay. 
 23 My Oga God, 
wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini 
and dem nor get di pawa to know 
wetin go happen to dem. 
 24 Abeg God, 
make Yu korrect wi wey bi yor pipol. 
Make Yu nor ponish us 
bikos Yu dey vex, if not, 
all of us go die finish. 
 25 Make Yu vex well-well 
for di nashons wey nor gri woship Yu 
and doz wey rijet Yu, 
bikos dem don kill and distroy yor pipol finish 
kon turn awa land to desert.”