2
Peace Wey Nor Dey End 
 1 Dis na di message about Judah and Jerusalem wey God give Isaya wey bi Amos pikin. 
 2 Time dey kom wen di mountin where di temple dey, 
go dey important pass evry oda mountin. 
Many nashons go-go der 
 3 and pipol go dey sey, 
“Make wi klimb go God mountin. 
Yes! Make wi go Israel God Temple, 
den E go tish us wetin E wont make wi do 
and wi go waka for di road wey E choose. 
Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem 
and God dey tok to en pipol from Zion. 
 4 E go judge and setol kworel among nashons. 
E go setol many pipol kase. 
Dem go turn dia swod to ordinary blade 
kon use dia spear dey work for vineyard. 
Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem 
nor go train pipol to fight war again. 
 5 So, Jakob shidren-shidren, 
make wi waka with di lite wey God take dey guide us!” 
Judgement Day 
 6 My God, Yu don forget yor pipol wey bi Jakob shidren-shidren, 
bikos dem dey do majik for evriwhere for di land; 
dem dey go meet majik pipol 
just as Filistia pipol dey do and na strenjas bi dia friends naw. 
 7 Na silva and gold full di land 
and Israel pipol propaty nor dey finish. 
Horse plenty for dia land and dia shariot, 
too many to kount. 
 8 Juju still full dia land too 
and dem dey woship tins wey dem use dia hand take make. 
 9 Pipol dey bow dey woship dem, 
so my God, make Yu nor forgive dem at-all! 
 10 Dem go hide inside rock and dig hole for groun 
make dem for fit eskape from God vexnashon and en glory. 
 11 Di day dey kom wen God go honbol proud pipol 
kon disgrace sturbon pipol. 
Den na only God, pipol go dey praiz. 
 12 True-true, God wey dey lead di sojas for heaven 
don plan di day wey E go judge evritin, 
bikos E go disgrace di pipol 
wey feel sey dem get pawa and dey make mout. 
 13 E go distroy all di tall cedar trees for Lebanon, 
with di oak trees for Bashan 
 14 kon level di high mountins and hills, 
 15 with evry high towa and strong wall. 
 16 Yes! E go sink and distroy 
big and fine-fine ship. 
 17 For dat day, God go distroy 
doz wey dey karry body up 
kon disgrace sturbon pipol 
and na only en name pipol go dey praiz. 
 18 E go distroy all di juju 
dem finish. 
 19 Wen God won kom shake dis eart with en pawa and glory, 
pipol go hide for hole, inside rock 
den dig hole for groun so dat dem go eskape from God vexnashon. 
 20 Wen dat day go rish, 
pipol go karry di gold and silva juju wey dem make for demsef 
kon trow and abandon dem give rats and bats. 
 21 True-true, wen God go kom shake di world, 
pipol go hide inside hole for rock, 
so dat dem go fit eskape from God vexnashon and en glory. 
 22 So make una stop to trust human being, 
bikos dem just dey breath thru dia nose. 
Wetin dis pipol bi sef? 
So make una stop to trust human being pawa. 
All of dem go die one day, 
so how dem won take help una?