7
Israel Sin 
 1 “Wen ever I sey I won heal 
and make my pipol, Israel prosper again, 
dia wikedness and di bad-bad tins wey dem dey do, 
nor dey allow mi do am. 
Samaria pipol dey shit each oda 
and dey do bad tins. 
Dem dey break enter pipol house 
and dey tif waka for street. 
 2 Dem nor know sey, I remember 
all di bad-bad tins wey dem do. 
Dia sin plenty well-well 
and I dey si all di wiked tins wey dem dey do. 
 3 Di pipol dey deceive di king and en ofisas 
with all dia evil plans 
and di prince dem dey make di king happy 
with dia lie-lie words. 
 4 All of dem dey sleep with who dem nor marry. 
Dia body dey hot like oven wey dem won take bake bread, 
bikos of di bad tins wey dem won do. 
 5 Wen di king dey do party, 
en and en ofisas dey drink well-well 
and dem go dey make plans with yeye pipol. 
 6 Yes, dia plan dey burn like hot oven. 
Dia vexnashon dey hot well-well for nite 
and wen dey break, e go rush kom out like fire. 
 7 All of dem dey burn well-well like oven; 
dey kill dia rulers one-by-one 
and yet, dem nor gri kom meet mi 
make I for help dem.” 
Israel And Di Nashons 
 8 God sey, 
“Efraim pipol bi like bread wey nor don. 
Dem don join and put hope for di towns 
wey dey round dem 
 9 and dem nor know sey na dis trust 
wey dem get for strenjas, distroy dia pawa. 
And naw, wahala dey kom, 
but dem nor know. 
 10 Israel pipol sturbones dey work against dem. 
Even with evritin wey don happen, 
dem nor still gri turn from sin 
kom meet di Oga wey bi dia God. 
 11 Efraim pipol dey waka up-and-down 
like bird wey dem dey kwik deceive; 
dem koll Egypt pipol make dem kom help dem fight; 
but afta, dem run go koll Assyria pipol too! 
 12 But as dem dey waka up-and-down, 
I go trow net wey go katch dem like bird. 
I go ponish dem for di evil tins wey dem don do. 
 13 Dia own don finish! 
Dem don forget mi kon dey do wetin I sey 
make dem nor do, 
so I go distroy dem. 
I won save dem before, 
but dem nor dey woship mi from dia heart. 
 14 Dem nor dey pray give mi with all dia heart. 
Instead, dem dey pritend dey kry 
and take body nak dia bed, 
just as doz wey nor know God dey do. 
Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, 
dem dey kut demsef like sinnas 
and dem nor gri do wetin I tok. 
 15 Even doh sey na mi train and make dem strong, 
dem still plan against mi. 
 16 Dem dey always waka leave mi 
go meet and follow oda gods wey nor get pawa. 
Dem nor dey stabol; 
dem bi like bow wey bend. 
Bikos dia leaders dey tok anyhow, 
dia enemies go kill dem, 
den Egypt pipol go laf dem well-well.”