5
From Adam Go Rish Noah 
 1 Dis na di rekord of Adam family. Wen God kreate human being, E make dem just as E bi.  2 Na both man and woman E kreate kon bless and koll dem, “Human being.” 
 3 Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.  4 Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.  5 Di total days wey Adam live, na nine hundred and thirty years and e kon die. 
 6 Wen Seth don stay for one hundred and five years, e kon born Enosh.  7 Seth dey for eight hundred and seven years again and e born some oda sons and dotas.  8 Di total life wey Seth live na nine hundred and twelf years and e kon die. 
 9 Wen Enosh don stay for ninty years, e kon born Kenan.  10 Enosh stay for eight hundred and fifteen years afta e don born Kenan and e born oda shidren.  11 Di total life wey Enosh live na nine hundred and five years, den e kon die. 
 12 Wen Kenan don live for seventy years, e kon born Mahalalel.  13 Kenan live for eight hundred and forty years afta e born Mahalalel and e born oda shidren.  14 Di total life wey Kenan live na nine hundred and ten years and e kon die. 
 15 Wen Mahalalel don live for sixty-five years, e kon born Jared.  16 Mahalalel stay for anoda eight hundred and thirty years afta e born Jared and e born oda shidren.  17 Di total life wey Mahalalel live na nine hundred and ninty-five years and e kon die. 
 18 Wen Jared don live for one hundred and sixty-two years, e kon born Enoch.  19 Jared live for anoda eight hundred years and e get oda sons and dotas.  20 Di total life wey Jared live na nine hundred and sixty-two years and e kon die. 
 21 Wen Enoch don live for sixty-five years, e kon born Metuselah.  22 Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.  23 Di total life wey Enoch live na three hundred and sixty-five years.  24 Enoch waka with God, den e vanish, bikos God take am. 
 25 Wen Metuselah don live for one hundred and eighty-seven years, e kon born Lamek.  26 Metuselah live anoda 700 and eighty-two years afta e born Lamek, en brodas and sistas.  27 Di total life wey Metuselah live na nine hundred and sixty-nine years, den e kon die. 
 28 Wen Lamek don live for one hundred and eight two years, e kon born boy.  29 E koll di boy Noah kon sey, “Dis one go give us rest from all di hard-hard work wey wi dey do from dis groun wey Oga God don curse.”  30 Lamek live for five hundred and ninty five year afta e born Noah and e still get oda shidren.  31 Di total life wey Lamek live na seven hundred and seventy-seven years and e kon die. 
 32 Afta Noah don stay for five hundred years, e kon born Shem, Ham and Jafet.